EXPERIENCE NIGERIAN PIDGIN

about the centre | what we do | research update | support us | staff and membership | experience nigerian pidgin | publications/bibliography | guest book | news contact us | our links

DIS NA DI OGBONGE NIJIRIA PIJIN ESPIRIENS
This page is intended to give you a first hand experience of the good flavoured natural Nigerian Pidgin in the following texts and translations.
Overview

. Pijin Parebol dem
. Saam numba twenti-tiri
. Propa Hai Song fo Kres Dog we

Pijin Parebol dem (Pidgin Parables)

1. If sinek enta haus weda na man kil di sinek, weda na wuuman,weda na vistor, no mata,bot na mek dem kil di sinek na im mata.
2. I gud mek pesin bi pikin, bot no mek pesin to bi pikin te.
3. No aks frog mek i giv yu che sidon bikos im bendan and i no si che sidon.
4. Na ai no noh na im mek rat tok se im wan folo pusi fait.
5. Di bed we stand fo rop no go fest as di rop tu no tek rest.
6. Wudpeka fit put hol fo wud bot i no fit put hol fo ston.
7. Frog se im no fit wet fo tumoro na im mek am kot im tel komot.
8. Ai go du am tumuro na im bi di left hand we de spoil beta beta tins.
9. Pesin we no want kata kata fo im fud we im de kuk, mek im no bai maket fo kredit.
10. Monki we want si honta fes na im de fest risiv bulet fo fes.
11. If sonn tink sei im get pawa pas mun mek im tu shain fo nait.
12. Tri we no sabi dans na briz go tich am.
13. Wen tu elifant fait na di gras dem de sofa.
14. Rat no de tak se im de luk wetin de hapun fo wie pusi dem de du paati.
15. Na bikos kamelon want mek everi tin bi di sem nai im mek am de chenj im kolo to evri tin we de araund dam.
16. Goht we tait im fes fo maket no min se dem no go praiz am.
17. Pesin we de drink wota no de yuz di sem maut tek de blo wiso di sem taim.
18. Na wen weda gud na im pesin de tek pripie fo weda we no gud.
19. Na lezi fama de komplen se im kutlas no shap.
20. Pesin we no de aks kweshon na im no de noh enitin.

(b) Psalm 23 (Saam numba twenti-tiri)

God na mai shepad,
Ai get evri tin we ai nid.
I de let mi lai daun fo fild
we grin gras de.

Na fo wie wota dem we kul and kwaiyet
Na die im de kare mi go
Mek mi mai fo get niu pawa

I de hold mai hand to tek tek mi pas di koret rohd
As im promis mi
Ivun if di rohd pas insaid wie daak wel wel
Ai no go fie eni denja, bikos God de fo mai said
I kare im aiyon rod and im wokin stik to tek de shou mi se notin go hapun to mi.

Yu pripie big paati fo mi
wie ol mai enimi dem go fo si mi
Yu bles mai hed oyel to tel welkom mi
and yu kom puo di beta beta drink ful risch di maut of mai kop

Tru tru, di gud gud tins we yu do fo mi
And di lov we yu shou mi
Go de wii mi fo mai laif evride
God, na fo yo haus na im ai want to de ste
evride evride fo mai laif.

Propa Hai Song fo Kres Dog we Dai
(A translation of Oliver Goldsmith's "An Elegy on the Death of a Mad Dog")

Gud gud pipol we de difrend difrend
Mek una let una iye katch mai song
And if i kom bi se i de shot and swit
Mek yu no veks se i no ste wit yu te.

Fo Islington wan man kom de
We evribodi fo wold fit tok se
Dat man na beta beta im stil de du
Wen dem si am se i de go pre.

And na soft haat we gud na im get
To tek kwench di problem dem fo laif
fo im frend and enimi dem
Pipol we de neked na evride i de kova dem
wen im kare klot go put fo dia bodi

I kom bi se fo dat taun wan dog kom de
Ivun as meni meni dog dem de die
Laik mongrel, poppy, whelp and hound dem
And ivun sef di dog dem we yeye we wel
we dem no get respet atol kom de fo dis taun tu.

Dis dog and dis man fo dat biginin taim
kom bikom tait tait frend
Bot as wan dei kom risch,
Di dog im kom bigin sabi de praud
Di dog wan kom let di man noh se
na im bi di propa ogbonge dog fo taun
Na die kres fo kom enta di dog hed
No du no du, im kom bait di man.

Fo evriwie, fo di strit and fo di rohd dem
pipol kom stat to de ron op and daun,
Nehbo dem kom de wonda and de ron
Ol di piopl dem fit swie se di dog hed no de haus
Fo am to bait dis kain gud man we de du gud gud tins.

Di wund kom bi laik se i kom ton to soo
we de mek pipol dem de hapi
Na so i kom bi fo di kristen dem aiy
And as dem de swie tek tok se di dog de kres
Na so dem kom de swie tok se di man go dai.

Bot i no kom tu te bifo wetin sopraiz evribodi kom hapun
We shou se na lai di yeye pipol dem tok
Di man kom rikova fain fain from di bait
we di yeye kres dog bait am
Na di dog na im kom dai yamutu.